Title: Leave Me Be (,Krio-leaning) Intro Eh eh. Ya listen well oh. Verse 1 I nuh go die for you, dat nuh be my fight, I nuh go cry for you, you get mama who sabi cry. I nuh go smile for you if rent never paid, Abeg bring money first, joy nuh dey on credit, babe. I nuh go cook for you, na chef you come find? Pot nuh be romance, hunger nuh be my destiny. I nuh go lie for you, na prison you wan find? Truth dey my mouth clean, I nuh dey risk my life. I nuh go lay for you, na ashaw you dey find? Respect first oh boy, nuh cross my line. Pre-Chorus If love na peace, den we fit talk, If na wahala or palava, abeg let me walk. Chorus Boy please leave me be, I nuh want wahala, I nuh want palava, I just dey sip my tea, soft life na my matter. Boy please leave me be, before you enter my peace, I nuh get time for drama, I dey look for my cheese. Boy please leave me be, leave me be, leave me be, Na money I dey find, not your fantasy. Boy please leave me be, abeg let me free, Go find your sister, go find your mama, leave me be. Verse 2 I nuh be your therapist, I nuh be your bank, You dey talk sweet plenty but pocket still blank. Love nuh be suffering, love nuh be debt, If stress na all you bring, boy I disconnect. You say “baby be patient,” patience nuh pay rent, Bills nuh dey wait for promise or sentiment. If you nuh fit add value, nuh come dey subtract, I dey build my future, facts upon facts. Pre-Chorus Love nuh suppose heavy, love nuh suppose loud, If peace nuh dey with you, abeg pass me by. Chorus Boy please leave me be, I nuh want wahala, I nuh want palava, I just dey sip my tea, soft life na my matter. Boy please leave me be, before you scatter my peace, I nuh get time for chaos, I dey look for my cheese. Outro Soft life only. No stress. Tea still hot Boh boh, leave me be.