
BAD BELLE (REMIX) — Ajuju-SQ Omo, life don teach me many lessons, No be everybody wey smile be your person, When the road rough, na only few remain, When the money show, everybody know your name. I dey hustle lowkey, I no dey make noise, I dey build my future, I no dey chase boys, Dem dey watch my movement, dem dey monitor my step, But I no send anybody, I dey focus on myself. Bad belle dey ask, “why this guy dey shine?” My brother, na hard work plus the grace divine, You see the little blessing, you no see the tears, You no know the battles wey I fight for years. I remember those days when nobody dey call, No food for table, still I stand tall, Now if I make progress, dem dey talk behind, But I no go carry hatred inside my mind. Make dem talk, make dem laugh, make dem say wetin dem like, I don already choose my own direction in life, If God open door, who you be to close am? If blessing locate me, who you be to stop am? I no wish you bad, I no wish you pain, But if you hate my sunshine, I go still see rain, I go pray for my people, I go pray for my lane, Because tomorrow fit bring another kind of change. Bad belle, I see you from afar, You no need to tell me who you really are, I no dey fight you, I dey chase my dream, One day you go understand what the struggle mean. Ajuju-SQ, I dey tell my story, From the bottom, I dey reach for glory, No shortcuts, no fake connection, Na God, hard work and determination.

