United States Department of Homeland Security tok say dem arrest one Nigerian man, Chidozie Wilson Okeke, ova im alleged previous criminal record of "assault and illegal drugs possession". Inside one footage wey dey circulate ontop social media, e show how US Immigration and Customs Enforcement (Ice) agents drag Okeke for floor wit handcuffs, afta dem drag am out of di hospital and put am inside dia vehicle. Di incident happun for Wyckoff Heights Medical Center, for New York on Saturday night. On Saturday night, protest bin break out for front of di hospital ova Okeke arrest by di federal enforcement agency, resulting in di arrest of some of di anti-Ice agitators. Many of di anti-Ice agitators gada for front of di hospital to protest against di mass deportation by Ice under di President Donald Trump adminstration. However on Monday, Ice tok say dem arrest Okeke becos of im alleged illegal possession of drugs and di overstay of im visa for di kontri since 2023.