*Title: Zicmoney Hustle Eh eh, money must locate me God dey my back, e no go delay me Oluwa, bless the work of my hands I dey grind, I dey stand Morning come, I don already wake Pray to Baba God, make my life no shake Pocket dry but my vision dey full Hungry today, but tomorrow belleful Dem no see the nights wey I dey cry Dem only see the shine when I pass by Omo, na God dey write my story From zero to plenty, e go be glory No be jazz, na pure grace One day dem go know my face Deep money hustle, I dey find my own Oluwa guide me, I no dey alone From trenches to riches, e go show


