
TRUST ISSUES Wazo Bala - Blood, Sweat & Faith Project (Copyright © Haddeubal, 2025) No trust, no peace, omo life be test Dem go smile, but dem wan my breath See my name, see my flex But inside, I dey feel distress Man dey climb, all dem boys dey change Same ones wey dey laugh my name Now dem dey call, dem dey talk, dem claim Say "Bro, we dey with you since day one" Omo, no be so e be Where una dey when I chop defeat? When I sleep for floor, no light, no heat Now dem dey talk like say dem be team See the girls wey dey ghost my line Now dem text, say "Omo, you dey shine" But I know, say love be blind She dey love my flex, she no love my mind I no fit trust nobody I no fit love too deep Dem go smile for my table But inside, dem dey wish me RIP Omo, I no fit sleep Too much pain wey dey hunt my dream I dey pray make Baba God guide me Cuz this life no be easy I dey see shadows wey no dey there I dey hear voice wey no dey near Dem go say "Boy, relax, no fear" But omo, this life no be fair Omo, no fit dey too close I dey love, but me I love with force If I open my chest, I fit lost So me I lock am, omo, case closed Is it me? Or na dem? Is it life? Or na scam? If I fall, who go stand? If I cry, who go care? I no fit trust nobody I no fit love too deep Dem go smile for my table But inside, dem dey wish me RIP Omo, I no fit sleep Too much pain wey dey hunt my dream I dey pray make Baba God guide me Cuz this life no be easy I no fit trust nobody I no fit love too deep Dem go smile for my table But inside, dem dey wish me RIP Omo, I no fit sleep Too much pain wey dey hunt my dream I dey pray make Baba God guide me Cuz this life no be easy

