[Intro] [Verse 1] I dey wait for your green light baby (baby) When you go gree to come my way I don dey hold on baby (baby) Anytime you want just reach my place you just dey tease me baby these games wey you dey play I no give up for your case [Pre-Chorus] I no go rush you o remain small i go still catch you o the things wey I don plan o I no fit talk am for mouth o [Chorus] my baby my lover I no go tire, I fit wait forever my baby my lover No dey doubt me, I go do you wella (I no go rush you o) [riffs and percussions] .[Verse 2] I just dey hope say na you dey call my phone o Every day wey pass, na your face dey my mind o The wait dey sweet me small, but e dey pain me true true Why you dey do like this i know say you want am too [Pre-Chorus] I no go rush you o remain small i go still catch you o the things wey I don plan o I no fit talk am for mouth o [Chorus] my baby my lover I no go tire, I fit wait forever my baby my lover No dey doubt me, I go do you wella (I no go rush you o) [Bridge] Even if e take forever, I no go mind Cos wetin dey for you, na the right kind So make you dey tease me, make you play your game At the end of the day, na my own go still remain [Chorus] my baby my lover I no go tire, I fit wait forever my baby my lover No dey doubt me, I go do you wella [Outro] I no go rush you o remain small i go still catch you o I no go rush you o remain small i go still catch you o I dey wait for you green light baby... my baby my lover, I fit wait forever... (fade)


