
TM — Ajuju-SQ Ajuju-SQ with another new vibe, TM, wow, see fine boy, see fresh guy, See my guy, see as e slim, Slim like toothpick, tell me wetin dey happen? You say na Tramadol dey give you the vibe, You dey take am, you dey feel so high, You say ganja better, you say na your style, But my brother, no let the matter carry you wild. See that ice wey you dey take, Na the same thing dey make some guys slim like toothpick, You dey look fresh, but check yourself well, No wait until your body begin tell you say “help.” My guy, I dey talk to you direct, No be every high wey sweet you must collect, Many people don lose their life because of high, Dem think say na enjoyment till dem no wake up again. My brother, please, my sister, please, No let pressure make you lose your peace, If you dey use anything, know yourself, No come dey do pass yourself just to impress. You fit see one guy dey flex for street, Tomorrow you hear say something don happen, Life no be movie, no be something to gamble, Protect your body before the matter turn trouble. Ajuju-SQ, another new vibe, I dey talk my mind while the Afrobeat ride, Fine boy, fresh guy, take care of your life, No let temporary high take away your whole life.

