
BAD BELLE — Ajuju-SQ Some people smile when dem see you rise, But deep inside, dem dey pray make you fall, You show dem love, dem return am with envy, Na why I dey careful who I call my own. I no dey compete, I dey mind my lane, If I get small, I thank God for the gain, Bad belle people fit talk all day, But their talking no go stop my way. Yesterday dem laugh when the pocket dry, Today dem see small light, dem dey wonder why, I tell myself, “my guy, just keep your faith,” Because every little step fit change your fate. Dem fit gossip, dem fit carry story, Dem fit twist your name just to spoil your glory, But I no get time for unnecessary fight, I leave everything for God, make He judge right. I know where I come from, I know my pain, I don walk through fire, I don dance in rain, If tomorrow bring blessing to my door, I no go use am to oppress nobody anymore. Bad belle, make you rest, Na God dey give man success, You fit hate me, you fit doubt my dream, But you no fit stop wetin God don plan for me. I keep my head high, I keep moving, No matter the pressure, I keep improving, Ajuju-SQ, na my story I dey tell, If you no wish me well, I wish you well.

