
Men dey fall.... men dey rise In between, some men are born Life get plenty faces, na why men dey run... dis rat races Oya... let put dis statistics down, In this world, how many child fit afford one plate of food. Shey... i lie ....some parent no fit pay for one pills of paracetamol Dis greedy belly men, see down for.... dis big pot of stew... Ah ! bet Why? Play politricks... kill the innocent, pay banditry service from our national budget... haa bar !!! Dis kind wickedness, no just gel Or... i don dey craze... all of this billions wey dem dey. See dem for TV... with dem big grammar Promise light... but there is no light at the end of the tunnel Many years don pass... our road still be like river.... Ha bar !..... for the road wey you collect plenty billions Hospitals come be like motuary... But all of you, dey travel go abroad... to get this treatment Wey Nigerian Doctor's, dem be one of the best Make you check am for yourself, is that not senseless I sick... I tire..... for dis matter, dis Greedy Belly are Ruthless. Naija... Naija used to hold my head, "Arise my Compatriots" Haa be, na "Nigerian we Hail thee", Confusion everywhere... Like say we Nigerians are daft... we fit no talk today But one day, Monkey wey don work... Go chop, Baboon as food. Naija still dey stand... I pray make hin never fall ....down yet But God, make I no lie... I dey tire... to dey see my people suffer. Ah... suffer, suffer... how much man fit endure? Children dey dream with empty belley... tomorrow no sure Dem chop... we dey pray... make heaven hear our cry How long we go dey survive... before another mama cry? Ah... suffer, suffer... this burden heavy well Graduate dey hustle... opportunity don sell Dem chop... we dey wait... but hope no dey expire One day... one day... justice go quench this fire

